
Nigeria vs South Africa rivalry don pass ‘be kiaful’? – Wetin dey happun.
Di Nigeria High Commission for Pretoria, South Africa don cut warning for Nigerians wey dey South Africa ahead of di 2023 Afcon semi-final match.
Di High Commission advice di Nigeria community to shine dia eyes well-well and make dem carefully choose wia dem go watch di match wey go shele on Wednesday 7 February, 2024 for di Buoake Stadium.
For di statement, di Nigeria High Commission say na sake of some “potentially imflammatory online comments wey some section of South African citizens dey make against Nigerians wey dey live for di host kontri” make dem bring out dis advisory.
Dem add say some of di comments na threat against “Nigerians wey dey cook jollof rice, bifor di match and “to show pepper to Nigerians if di Bafana Bafana lose to di Super Eagles.”
Make dem also avoid comments wey go provoke pipo and too much celebrations wey fit cause kasala if Nigeria win.
Leave a Reply